Our mumu don do:
We don know wetin we dey do.
As hunger take ground full
Na only you dey belle full.
Shey you think say we be fool?
Abba, we no be like Johnbull.
That your face like ‘come and do’
No fit mumu us for round two.

Dat time wey we dey school
When we dey learn two-plus-two
Our books we take as a boo
Say education na im be the tool
Wey go later give to our shoe
That ‘ko-ko-ka’ wey dey cool.
With street-waka for wetin to dey do
‘Pe-re-re’ na im say after school.

When time reach to go to the poll
Na then our group you go belong to
You go come be our paddi for ghetto
You go come dey share rice for bowl
You go come street; come eat ‘koko’
You go come dey pack gutter and so.
When you get votes, and election don go
You go come forget us for ghetto.

For your eyes na like say you sharp
Like say make I dey give you clap.
While hunger dey tear people slap
Milk and honey dey flow for your tap
You dey chop fried rice and chicken lap
And you pass with your ‘boning’ cap.
Our Panadol don turn ‘Panasharp’
Now, our votes go land you hot slap.

E tey wey we don dey shut up
But now we don com wise up.
As things don make us fed up
And our blood don com tensed up
Na im com make us to stand up
And get battle ready to fire up.
All of you wey don fuck up
Our votes go tell you what’s up.

BY OYESOMI EMMANUEL